BIRMINGHAM CITY SEND ROONEY GO HIM PAPA HOUSE AS BOBO WAN SEND DEM GO VILLAGE



Wayne Mark Rooney wey dem born 24 October 1985 na former  English sabi player wey also hold body tight for Manchester United.

The time wey him still dey ball, na ogbonge player him be and many pipu see ham as  one player wey fit 'Eat strong eba and no go drink water' among pipu wey dem dey ball together.Na Rooney shake the back of the net pass for  Manchester United and England national team from 2015 to 2023.

Him performance as ogbonge player come make some clubs think say the guy go sabi tell players wetin them go do for field and them carry him as coachi but the guy dey fall hand weller because na awoof him team always be for any of him opponent, because, dem dey beat han for him backyard come dey also popo ham for any corner for outside.

Birmingham city wey be de club wey him coach last today don send ham go him hin papa house because as dem say the bobo no sabi anything and him dey "carry dem go where dem no know".

The bobo don relegate DC united, Derby County and now he wan relegate Birmingham City as he carry dem from number five position to nineteen now on the table.

Comments

Popular posts from this blog

Chief Oladokun Jeremiah paid courtesy visit to Yagba East Caretaker chairman, Hon. (Dr) Joshua Dare to congratulate him

Ebi Egbe gives proffessional advise ahead of Super Egales games against South Africa and Republic of Benin

Hon. Dare Joshua(Venza) assumed office with enormous praises on Yagba East Local Government residents,promise not to let them down.